kayster

warri langua

kayster
warri langua

6 Plays

28 Jun 2020

if I no feel myself, na who go hype me you wey your best wish for me na rip I no be newcomer I no be jjc for this denkwe, na me dey run the whole ap if money na kpo kpo I wan go prison yard no mind take many years arrange myself behind bars my words sweet die e be like candy bars the difference between me and you na aboki and adidas all these oturukpe people dey form boss for Instagram but if you check am well,client never balance the money gram if you get things to say to me say am to my face if I find out from behind na consequence you go face say these umunnachi people don follow me reach here but when dibia call my name na bros j dey appear otulo swallow 30 million boys still dey beg for street abeg o wey we government no be weytin we agree you dey run small gee level na e you take loud am? weytin dem do hush pupi shey you never hear am? my guy even to do gee now no too dey pay forget all these celebrity lifestyle all of them na fake okay oghenedo commot for denkwe go Ghana na so we dey reason am, he think say he clever carry like 5.5 go learn gee with e guys for bunker when money finish nobody tell am na leg he use come back my popsie na man of God say my style na worldly music me I no send I dey my room dey add to my playlist star boy when I dey for school all the girls dey fall I never get bad mind then I dey run when they open pinafore they say na me be the best for denkwe na me get the ap rap battle everyday nobody fit beat me you na VIP me be piv translate am omo that na poor international victim I wake up everyday others dey live my dream the day wey I go commot for denkwe e go be like film all these words wen I dey drop na straight from my head I no fit start to smoke inspiration full my head who go blow go blow na time e go take I no fit come here dey exchange dry flows with all these fake you call yourself my gee con dey reason my babe na your main I go corner when I wan retaliate

1 Comments

Leave a comment

4 years ago

You may also like